HOW TO MESS (FART) IN PUBLIC & RETAIN YOUR IMAGE.

To mess for public dey sweet but if dem catch u, no be small embarrassment o! Just follow dis guidelines & u are on your way to being a star in this profession.

1. Wen u enter a hall, check d wind direction,if na closed hall wit air condition or fan,beta 4 u.
Maximum impact.

2. Make sure say u sidon face d wind
direction....

3. Make sure say u get enof left space. U go soon knw why!

4. Form ajebo by crossin ur legs every now & then.

5. U don ready 2 execute, try hold
am until time wey the hall dey noisy in case ur fart na the type wey dey sound like AK47.

6. Now carefuly cross ur leg, right
over left.

7. Elevate the right yansh.

8. Release small (sound check)

9. If no sound, allow make d mess flow steady.

10. Allow time 4 proper circulation.

NOTE:
1. Make sure say no be u be d first person to complain.

2. Wen pple begin dey shout "Jesus" who do dis wan. E no go better for d person wey do dis kind thin," simply ask "why som persons no fit respect demselves 4 public places? na wa o"

3. No shout pass odas if not u go become suspect.

4. Take style disengage from d area, relocate to another zone and repeat d exercise!
Trust me,u will go places wit dis profession. d world must hear of u more dan Micheal Jackson.

Comments

Anonymous said…
Jesus christ oo dis guy is so mad

Popular posts from this blog

Mr. Best denies having intentions for the office of the D.O.S in the forthcoming S.U.G election.

Meet The Woman With World's Biggest Boobs, Jenna Curlington.